fbpx
April 26, 2024

Police don discover one baby factory inside Nasarawa State

0
Man-kpai-for-ful-station-for-Oyo-State-

Di Nigerian Police Command for Nasarawa State don discover one baby factory wen dey operate under the license of orphanage home for Karu Local Government Area, for Nasarawa state.

According to wetin DSP Ramhan Nansel, Police Public Relations Officer (PPRO) for di state yarn tori pipol on Wednesday for Lafia.

U FIT ALSO READ Why I arrange make dem kidnap my husband.

Hin tok say di officers wen dem attach to Police Area Command, for New Karu discovere di baby factory for Ado Kasa on Thursday.

Di police team arrest four suspect for di building and also rescue six young girls and one baby of about six months.

Hin tok say di owners of di factory dey operate illegal orphanage, St. Bridget Orphanage Home, where dem dey carry out all dia illegal business.

According to di police, di owner of di orphanage dey abduct underage pregnant girls and hold dem down against dia will till dem deliver babies give her.

Nansel tok say na rich pipol dey buy most of di children wen dem dey delivere for di orphanage home.

Di PRO tok say di command don hand over those suspect and di victims to di National Agency for di offence of human Trafficking for further investigation and prosecution.

Hin tok say di Commissioner of Police, Maiyaki Muhammed-Baba, don give order to di command to mobilise guys to go after those criminals wen dey operate for di state and hi don tell parents to make sure say dem take care of dia children.

Di commissioner also tell members of the public to make sure dey give police pipol credible information wen go assist dem to catch criminals for inside di state.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *