fbpx
April 27, 2024

Naira redesign no be di economy priority — CISLAC

0
500-and-1000-naira-notes-CBN-decision-Priority

Di Civil Society Legislative Advocacy Centre don yarn say di Central Bank of Nigeria  plan to redesign 200, 500 and 1,000 naira notes no be di economic priority for di country. That is, if pipo wan look di current challenges wey di economy dey face.

Di Executive Director of CISLAC, Auwal Musa, yarn this matter for inside statement on Thursday. Hin add say important things dey wey di CBN suppose dey attend to so that di economy go better again.

Musa add say di way wey Nigerians react to di announcement naa proof say di decision na misplaced priority on di part of di CBN.

He yarn say di matter were di CBN suppose dey worry about na to protect foreign exchange reserves from external outflows, make forex dey available to the ordinary citizens wey genuinely and legitimately need am. He add say di huge blow to foreign direct investment dey equal to the inability of di CBN to do dia job well.

Di full tori dey inside Punchng…click here make you go read di remaining one…READ MORE

Experts yarn say di decision to change naira design dey positive for economy

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *