fbpx
April 26, 2024

UK don license 91 Nigerian doctors in 15 days

0
UK-liense-Nigerians-doctors

Di United Kingdom General Medical Council don license fresh 91 Nigerian-trained doctors.

We hear say di accreditation of di 91 doctors happen for 15 days between October 10 and October 25, 2022.

Di total number of Nigerian-trained doctors for UK now na 10,387.

Dem reach 5,210 associate specialists, 2,318 doctors in training, 1,837 general practitioners, and 1,273 specialists among di 10,387 doctors.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

Accreditation of di 91 doctors start as di Nigerian Medical Association dey cry about di brain drain wey dey deal with di health sector.

Apart from doctors, other categories of health workers go migrate too.

Report wey enter, show di statistics between January 1, 2022, and September 30, 2022.

Na 1,307 Nigerian-trained doctors UK license as Nigeria continue to dey find solution for di worst situations of brain drain in history.

NMA yarn say if dem wan train di next generation of medical doctors and medical students, Nigeria need to keep di older consultants wey dey for their 50s and di one’s wey don dey reach retirement, so that dem go fit go back train di next generation of doctors and medical students…READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *