fbpx
June 26, 2024

Number of deaths for Nasarawa bomb explosion don increase to 56

Nasarawa-bomb- explosion-deaths-don-rise-to-56

Di number of deaths for di bomb explosion wey happen on Tuesday night for Rukubi, di border area between Nasarawa and Benue States don rise to 56 while di cause of di blast still dey unknown.

One resident of Rukubi, Mallam Haruna Bawa wey bin dey di scene of di bomb explosion yarn say dem count more than 54 lifeless bodies, including four of hin brothers.

For inside interview with  Saturday Vanguard for Lafia, Malam Bawa, wey bin follow dey Dalhatu Araf  Specialist Hospital, Lafia to attend to hin injured brother, yarn say hin rush go di scene of di explosion after hin hear  loud noise, see  thick smoke from di area.

According to am, “some of di pipo wey kpai  for di attack na butchers wey dem invite to slaughter cows.

FOR MORE NEWS: Nasarawa bomb explosion: “40 pipo don kpai” – Governor Sule

Additionally, di spokesperson of di Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria, Tasi’u Suleman, yarn say at least 54 pipo kpai instantly while di pipo wey get injury plenty.

Mallam Bawa, wey sustain plenty injuries for different parts of hin body, yarn say di explosion scatter hin legs but hin dey thankful to God for saving hin life.

Yet another victim of di blast, Mallam Adamu Abdullahi, claim say hin lose three of hin friends wey follow am go receive cows for di area. But, hin escape with  broken arm and deep cuts for hin belle and other parts of hin body.

Di victims dey call on di federal government make dem set up an independent investigative panel. This na so that dem go fit know di circumstances surrounding Nasarawa bomb explosion wey don cause plenty deaths, and so that di pipo wey do am go face justice.

You go like read di full tori…READ MORE