fbpx
June 17, 2024

Islamic group don advise NBC make dem ban portable new song

ban-portable-new-song

Di Muslim Rights Concern (MURIC) don call on di Nigerian Broadcasting Commission make dem ban Portable Portable new song, hin latest single.

MURIC Director Dr Ishaq Akintola make di call inside statement. Hin yarn say di controversial musician new track promotes diabolical actions and ritual killings.

Akintola tok say di song na open invitation to criminality and hin ask make government take action to reduce di harmful impact wey e go get on young people.

According to di statement, hin write say dem find di song disgusting, offensive and wicked. E tok say na bold assault on Nigerian and African values. Portable’s latest song don reduce human life to di level of ordinary ants wey another human being fit match for ground without consequences.

FOR MORE NEWS: Celebrities don attack Nedu over hin comment about BBNaija female housemates

He yarn say na open invitation to criminality. In addition, di song make mockery of law and order, and na open disrespect for human life.

MURIC advise di  government and concerned stakeholders make dem take di needed actions to sanction di singer.

For inside di statement, dem invite di National Broadcasting Commission (NBC), di National Film and Video Censors Board (NFVCB), di Nigerian Copyright Commission (NCC) and di Performing Musicians’ Association of Nigeria (PMAN) make dem take necessary action with military dispatch.

Hin yarn say security agencies suppose investigate di author of di most embarrassing and irrational song. This na because di song explain di number of rituals wey hin don do.

As a matter of fact, hin tok say dem need to make am scapegoat with hin album  before di trend escalates. To conclude, he say dem need to ban portable new song.

You fit go read di full tori…READ MORE