fbpx
May 4, 2024

National Domestic Card Scheme by Central Bank of Nigeria go start on January 16

National-Domestic-Card-Scheme-by-Central-Bank-of-Nigeria

Di National Domestic Card Scheme by Central Bank of Nigeria (CBN), go start on January 16, 2023.  CBN, in partnership with Nigeria Inter-Bank Settlement System (NIBBS), yarn say di scheme go unify payment for Nigeria.

On October 2022, Osita Nwanisiobi, CBN director of Corporate Communications, yarn say because Nigeria na Africa largest and most vibrant economy, e dey important make dem quickly adopt digital financial services.

FOR MORE NEWS: Banks wey dey borrow from CBN rise 260% to N21.87tn

Nwanisiobi yarn say if dem Consider di strength and breadth of dia banking sector and di rapid growth and transformation of dia payments system over di last decade, Nigeria fit successfully launch national card scheme.

According to report, CBN bin list functions of di card. Di CBN spokesman tok say dem fit use di card as a platform to disseminate government-to-person payments and other social initiatives to enhance financial access and support di growth of strong and inclusive digital economy.

Di National Domestic Card Scheme by Central Bank of Nigeria go reduce dependence on cash transactions. E go improve fraud management and enhance dispute management around card operating systems. Na NIBBS go deliver di card.

You fit go read di full tori…READ MORE