fbpx
May 5, 2024

Governors of di 36 states plan to meet di CBN, Godwin Emefiele

di-country-economy-go-suffer-if-cbn-no-extend-di-deadline-

Di present withdrawal policy naira notes wey dem redesign, don make di Governors of di 36 states plan to meet di CBN, Godwin Emefiele, on Thursday.

On Tuesday night, Abdulrazaque Bello-Barkindo yarn say di governors go exchange ideas with Emefiele.

Dia discussion go base on “di economic and security implications of di current withdrawal policy and naira redesign.

On October 26, 2022, CBN tok say dem wan redeign naira note. After di announcement, dem tell Nigerians make dem put old naira note for bank on or before January 31, 2023.

Di meeting go dey online and e go be on Thursday bu 9:00 pm.

FOR MORE NEWS: Ogun no give Atiku access to stadium for rally

As di spokesperson dey refer to di NGF’s Director General, Mr. Asishana Okauru, hin point am out say di virtual meeting go focus on di latest apex bank withdrawal policy and naira redesign. Na why di Governors of di 36 states plan to meet di CBN, Godwin Emefiele.

He mention di title of di virtual meeting, “The Economic and Security implications of naira redesign and withdrawal policy.

Di maximum weekly limit for cash withdrawals wey CBN bin tok for individuals and corporate organisations na N500,000 and N5 million, respectively.

CBN bin first reduce di weekly over-the-counter cash withdrawal limit for individuals to N100,000 and corporate organisations to N500,000.

Withdrawals for Automated Teller Machines and point-of-sale terminals na N20,000 daily.

You fit go read di full tori…READ MORE