fbpx
April 26, 2024

NATO chief support for Ukraine, Hin don make vow.

nato-chief-support-for-ukraine

NATO don pledge to “strengthen” support for Ukraine after dem sign joint declaration with di European Union on Tuesday January 10. NATO chief support for Ukraine na better news.

For once NATO neva shake leg for dia support for Ukraine since Russia launch dia invasion for February, with Western allies wey send billions of dollars worth of weapons and other aid to Kyiv.

Secretary of NATO, General Jens Stoltenberg on Tuesday, January 10 call di “strategic partnership” between the EU and NATO ” as something wey dey more important than ever,” as Russia invasion of Ukraine dey go 11 months.

NATO chief support for Ukraine

Stoltenberg yarn for Brussels say dem must continue to strengthen di partnership between NATO and the European Union, and dem must strengthen dia support to Ukraine. This na after hin sign di third joint EU-NATO declaration with European Commission President Ursula von der Leyen and European Council President Charles Michel.

FOR MORE NEWS:

Von der Leyen tell journalists say dem know say dem need to strengthen di support strong more than 20-year-old partnership because Europe security dey under threat.

EU-NATO partnership go dey  “even more important once Finland and Sweden become full NATO members with their accession,” von der Leyen added. still add

Di European Commission chief reference di sabotage of di Nord Stream pipelines as example of di need “to take more responsibility for di security of dia network infrastructure.”

She highlight di importance of keeping “di pressure on di Kremlin.” This na as she talk say EU go soon impose sanctions on countries including Belarus and Iran wey militarily support Russia war for Ukraine.

You go  like go read di full tori…READ MORE