fbpx
April 25, 2024

Newcastle settle for one point inside Bournemouth draw

0
Newcastle-v-Bournemouth.

Di Premier League don come back to action after dem postpone last weekend game because of di death of Queen Elizabeth II and dem bin observe one minute silence and dem follow sing national anthem for all di Saturday match.

For St James’ Park, Newcastle settle for one point for di fifth time for seven games this season as Bournemouth achieve 1-1 draw.

YOU FIT STILL LIKE: Newcastle race go get Isak available against liverpool.

Magpies manager Eddie Howe bin dey frustrated by hin former club, wey take di lead against di run of play for di 62nd minute when Phillip Billing stab for Jordan Zemura cross.

Newcastle’s £60 million striker Alexander Isak balance with 67th-minute penalty after one VAR check show Kieran Trippier as e cross hit Jefferson Lerma hand.

You fit CLICK HERE go read more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *