fbpx
April 20, 2024

Nigeria carry 1st position among other countries for Cannabis mattar — Buba Marwa

0

Di Chairmo and Chief Executive Officer, National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, Brig. Gen. Mohamed Marwa (retd), hin don come out tok say wen it comes to di use of cannabis for di whole world, Nigeria na hin take number one position. With over 10.6 million pipol for Nigerian bin dey abuse drug.

According to wetin hin be yarn for one health Summit like dat, Marwa tok say Nigerians get drug abuse problem.

U FIT ALSO READ Drug trafficking – Court don sentence lawyer to five-years in jail

Marwa tok say pipol no quickly notice am until 2018 wen United Nation Office on Drugs and Crime, UNODC-support National Survey on Drug con conduct research on di way wen pipol dey Use drug matter, dem dey up to 14.4 percent

According to survey he show say Nigerians dey consume more cannabis dan other countries like Portugal and the United Arab Emirates.

Di Zonal Commander for NDLEA, Lagos state, Dr. Segun Oke, wen bi represent Marwa for di event tok say “In 22 months, di agency don arrest up to 20, 000 pipol and don carry over 3,111 go court.”

NDLEA  don seize 5.5 million kg of drugs, at di same time don destroy 900 hectares of cannabis farms and dismantle two illicit methamphetamine laboratories.

Hin tok say next year go dey more tougher dan dis year becos, NDLEA don amend dia Act and he don give dem di opportunity to send traffickers go jail without any option of fine.

Prof. Olatunji Ainan, way bi Head, Department of Psychiatry, College of Medicine, University of Lagos/ Lagos University Teaching Hospital, Idi-Araba, Lagos, , tok say di current economic problem for di countri na hin worsen di mental health of Nigerians.

Di Presido of World Medical Association, WMA, Dr. Osahon Enabulele, don chook mouth for di mattar con beg Federal Government to pass Mental Health Bill to di house in order to address di challenges of mental health mattar for Nigeria.

.During COVID-19 pandemic, di burden on mental health mattar according to calculation he don increase to 25 percent.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *