fbpx
April 20, 2024

Police don arrest five guys wen dey impersonate EFCC operatives to defraud pipol for Delta State

0

According to Delta State Police Public Relations Officer,DSP Edafe Bright for one press release, hin tok say becos of different complains way dem receive from members of di public, especially from youths, dem tok say EFCC operatives dey usually break into dia house for night, and forcefully arrest dem, con still carry dem away go collect plenty money from dem.

Base on dis alignment na him make police pipol quickly carry bodi into action and according to some investigation way dem gather dem con tok say dem fit no bi EFCC operatives.

U FIT ALSO READ Police don arrest one Man wen beat hin wife to death over property, inside Ogun state

On 16th November 2022, di Command receive anoda complain from a one persin way dem enter hin house for night, according to tori we hear say those pipol enter di compound through jumping fence, and  dey forcefully carry di guy comot inside one white Toyota Hiace bus.

Di guy tok say after dem carry am reach on top of di Bridge beetwin Delta and Anambra State dey forcefully collect hin phones from hin hand and other valuable things wen worth three million, seven hundred thousand naira (N3,700,000), dey still tell am to do transfer of two million, five hundred thousand naira (N2,500,000) con still tell am say dem go still show for hin doormot again.

Five other pipol still give report to di Command on how those pipol take rob dem with a sum worth of fifteen million naira (N15,000,000).

According to di police, dem tok say he dey obvious say those pipol wen dey do like EFCC so no bi real EFCC say dem go bi hoodlums.

Di Commissioner of Police Ari Muhammed Ali don direct di Command Decoy Squad to investigate di matter well well and ensure say dem catch those guys.

On 23 November 2022, di Commander, CP-Decoy, ASP Julius Robinson, act according to one information way dem give dem way led dem into operation and trace those suspects to dia hideout inside one hotel way dey for Asaba where dem dey plan anoda operation.

Police operatives arrest Five suspects including Prince Allison, 29, way bi di leader of di gang way dey call himself EFCC contract staff for Portharcourt, George Chisom Onyeweagu, 29, an Owerri resident who dey carry POS waka for dem, Duke Okoro, 40, way dey live for Asaba, Delta State, Joseph Osinachi, 23, a that one dey live for Lagos State and Onyocha Stanley, 32, dat one dey live for Owerri.

Di suspects admit say dem dey quity of di offence say dem dey use di emblem EFCC  rob pipol for di town.

One white Hummer bus, two locally made EFCC jackets, one POS machine and eight mobile phones na him di police operatives collect fron dem.

According to di PPRO, investigation still dey go on and those suspects dem go carry dem go court for prosecution.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *