fbpx
May 3, 2024

Nigerian banks fit trade forex at any rate ― CBN

nigerian-banks-to-freely-trade-foreign-exchange

Di Central Bank of Nigeria, CBN don give Nigerian commercial banks go-ahead to freely trade foreign exchange at any rate.

Na after di announcement of Godwin Emefiele suspension as CBN governor na hin dis tori come out.

Plenty pipo believe say banks fit sell forex at market-determined rates, dem suggest say Nigeria dey operate a freely floating exchange rate.

Dis update dey in line with di promise of President Bola Tinubu to unify di multiple exchange rate for market.

However, official confirmation go come later in the day when data from the FMDQ dey available.

Also, sources reportsay trades dey go as high as N750/$1. Meanwhile, inside black market, di exchange rate trade for as high as N773/$1 for “inflows” wey represent dollars or other currencies wey dem dey sell over wires.

 

FOR MORE NEWS: “Tonight you get one”- Obi Cubana to host grand wedding ball for wife as they mark 15th wedding anniversary

 

According to reports, President Bola Tinubu last Friday, June 9 take Nigerians by surprise when he order di immediate suspension of di Central Bank of Nigeria Governor, Godwin Emefiele, from office.

Emefiele receive order to immediately hand over di affairs of hin office to di Deputy Governor (Operations Directorate), Mr Folashodun Adebisi Shonubi, wey go act as di Central Bank Governor pending di conclusion of di investigation and the reforms.

Di suspended CBN governor assume office in 2014 after hin succeed Lamido Sanusi, wey bin follow dey suspended from office under controversial circumstances by President Goodluck Jonathan few months before di expiration of hin tenure.

You fit go read di tori as CBN give go ahead to Nigerian banks to trade foreign exchange…READ MORE