fbpx
April 26, 2024

Odumeje declare Nigerian leaders failure, condemn attack on Igbos for Lagos

nigerian-leaders-na-failure-Odumeje-knock-political-leaders-

Prophet Chukwuemeka Ohanaemere, wey dey known as Odumeje, don knock political leaders and appointees over di state of Nigeria.

Di cleric yarn say di pipo dey suffer because those for high offices forget dem, while dem enrich dem sef.

Odumeje, for hin latest sermon, lament say Nigeria  dey go down every blessed day, while other nations see dia citizens “as nothing”.

Also, di spiritual leader of Mountain of Holy Ghost Intervention and Deliverance Ministry condemn di disenfranchisement of Igbos for  Lagos.

On intimidation and attacks wey happen during the March 18 governorship and house of assembly election, he yarn say di world “see everything very clear”.

“Somebody go come out say if you know say you be Igbo man, no come here. If you no fit vote for dis (person), no come here.

FOR MORE NEWS: I’m excited – Keyamo don react to Peter Obi petition for election tribunal

Accordig to Odumeje, look how brothers turn enemies because of pipo wey dey do dia business, dem make us enemies because of dia selfishness.”

On governance, di church founder warn government officials make dem stop to dey show dia sef as leaders because dem don fail.

Odumeje knock political leaders as hin lament say “No 24 hours light, no good road, no security, still dem dey call dia sef leader..

“All di pipo wey dey occupy any seat from up to bottom, suppose dey ashamed of dem sef.

Also, hin stress say make every youth of dis country no keep quiet for dia rights. Nobody own dia country.”

You fit go read di tori…READ MORE