fbpx
May 5, 2024

Reactions continue to trail President Tinubu nationwide broadcast

nigerians-views-on-tinubu-broadcast

Nigerians don express different views on Monday nationwide broadcast by President Bola Ahmed Tinubu.

Di broadcast majorly focus on hin policies on fuel subsidy removal, changing of di nation bad economy, education, di labour force and infrastructural development for Naija.

Inside Ilorin, Kwara State capital, some residents express doubts over di positive results of President Tinubu’s interventionist policies during di trying period of di kontri history.

Also, reacting to di president broadcast, Professor Moyosore Alao, Chairman, Academic Staff Union of Universities, ASUU, University of Ilorin chapter, yarn say di union position on students education loans neva change.

 

FOR MORE NEWS: Tribunal reserve judgment for Atiku petition wey want nullification of Tinubu election

Professor Moyosore caution Nigeria say make she no lose her sense of history and hin advise di government make dem learn from wetin dey happen for developed kontries like America, Germany and others in respect of educational loans.

In addition, hin yarn say na di government suppose to give grants and scholarships to brilliant indigent but poor students, so dat dem no go dey disadvantaged.

Di ASUU chairman yarn say na universities or a board with proper management suppose administer di to ensure compliance with global standards.

You fit go read di tori see Nigerians views on Tinubu broadcast…READ MORE