fbpx
May 5, 2024

Tribunal reserve judgment for Atiku petition wey want nullification of Tinubu election

tribunal-reserve-judgment

Di Presidential Election Petition Tribunal on Tuesday for Abuja reserve judgment for di petition of di Presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Abubakar Atiku wey want di nullification of di declaration of Bola Ahmed Tinubu as winner of di February 25 presidential election.

Chairman of di Tribunal, Justice Simon Tsammani, as hin reserve judgment, yarn say dem go communicate di date of di delivery to parties wey dey di argument.

Di major petitioner, Atiku, ask di Tribunal make dem do better justice to hin petition and make dem no do technical judgment wey fit spoil di course of Justice.

Also, hin insist say make dem disqualify Tinubu on di strength of di American Court judgment where dem make am forfeit $460,000 on narcotics and money laundering-related offences.

Atiku final address bin dey adopted by hin lead counsel, Chief Chris Uche SAN.

 

FOR MORE NEWS: “How church pressure me to marry my best friend” – Stella Damasus reveal

 

However, counsel to di All Progressives Congress, APC, Lateef Fagbemi SAN, encourage di Court make dem dismiss di arguments on di  ground say di judgement wey Atiku dey tok bin dey delivered over 30 years ago.

On hin own part, President Tinubu, wey dey represented by legal luminary Chief Wole Olanipekun SAN, yarn say di make dem dismiss di petition because di grievances of Atiku and PDP dey targeted at di Independent National Electoral Commission INEC.

Details later.

You fit go read dis tori  see why Tribunal reserve judgment…READ MORE