fbpx
May 5, 2024

“No Accept Her Back” – Dr Penking Dey Beg Alex Ekubo after Fancy Acholonu Public Apology

alex-Ekubo-fancy

Popular Nigerian Doctor and social media commenter,  Dr Penking don join some other angry Nigerians to condemn Fancy Acholonu wey be Alex Ekubo former fianceé over her recent public apology.

Fancy Acholonu, a model and entrepreneur, for her Instagram page, she wrap up di year by taking another shot at love.

Acholonu wey bin dey engaged to Nollywood actor, Alex Ekubo, for May 2021, suddenly call off dia already-scheduled wedding for August of di same year.

Over a year later, Fancy don make U-turn and she tender public apology to her former lover. She ask am make hin take her back.

FOR MORE NEWS: “He Buy Mansion, Break Am and Build Another”: Portable Turn Comedian As Hin Meet Footballer Emmauel Adebayor

For post wey dey Instagram on Thursday, Acholonu apologise for di hurt wey she cause her ex-fiancé and hin family by publicly announcing dia break up

She later tok say her heart still belong to di actor and she no wan lose am.

As she share picture of dia rosy times, na wetin she write be this “Like our shirt says, Nothing makes sense when we’re apart @alexxekubo you still have my heart. I miss you, I love you, and I’m truly sorry for all the hurt & pain you and your family went through with our break up.

You go like read di full tori…READ MORE