fbpx
April 19, 2024

No be joke, we meet with Tinubu, Atiku, Obi for London – Wike

0

Rivers State Governor, Nyesom Wike, on Friday stand gidigba say yes picture no dey lie, true true our team really do serious meetings with before before President Olusegun Obasanjo and some presidential candidates for London, and reason for the meeting nah matter of national interest, and to support the person wey we know say go fit komot Naija for this wahala wey we dey so.

Wike wey return from London on Friday with his men wey be Governors for Naija like governors of Benue and Abia states, Samuel Ortom and Okezie Ikpeazu.  Wike talk say, people don dey talk many many things concerning his trip to London, say e go do secrete meeting with Asiwaju Bola Ahmed Tinubu while some dey talk say na Peter Obi. Well picture no dey lie, nah meeting we go do but no be meeting with just one candidate, na meeting with the three candidates.

Wike said, “make I confirm this to you for the first time, nah true say we dey do meeting with presidential candidates of the three major parties. But the truth be say, whatever we dey talk, no be say one person one decamp or anything, the meeting nah on top serious national matter and e dey in the interest of Nigeria and for Nigerians.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *