fbpx
April 25, 2024

No more Okada activities from today, Lagos govt insist.

0
Sanwoolu\

3 years imprisonment for anybody wey dem catch and dem go say sara to dia motorcycle. The Okada rider and passenger na Im dey go prison together.

Few hours before the dem start the ban of motorcycle activities wey everybody know as Okada for inside four Local Governments (LGs) and six LCDAs, the Lagos State government on Wednesday pledge say he no go change im mind about the ban wey dem place on Okada. He don follow drop warning say anybody wey dem catch, both the riders and passengers go enter prison for 3 years and dem go scatter the Okada wey dey catch for everybody eyes.

Una go remember say the additional LGs be: Kosofe, Oshodi-Isolo, Shomolu and Mushin, with the affected LCDAs, including Ikosi-Isherri, Agboyi-Ketu, ​Isolo, Ejigbo, ​Bariga and Odi-Olowo.

You fit also like to read this one: Okada ban: Okada riders don pack dia self go protest for Lagos State House.

The state government bin don ban okada activities before for six LGs and nine LDAs, now everything don be 10LGs and 15LCDAs.

The State Commissioner for Transportation, Dr Frederick Oladeinde, bin pledge im own too when he dey give update about the ban for one press briefing wey happen for Bagauda Press Centre, Alausa, Ikeja. He tok say the people wey no follow the rules, go face punishment in line with the provision of Section 46, sub-section 1, 2 & 3 of the Transport Sector Reform Law (TSRL), 2018.

You fit go read more of this tori, CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *