fbpx
April 19, 2024

Aviation fuel price increase go affect operations.

0
Air\Marshal\Oladayo\Amao\

The Chief of Air Staff Air (CAS) Marshal Isiaka Oladayo Amao don raise alarm over the high cost of JET A-1 (Aviation fuel) for the country.

Amao tok say the matter of high Aviation fuel price wey dey shele like this, if government no handle am fast fast, e go affect the Nigeria Air Force (NAF) operations.

Since the anti-terror war start, NAF don dey conduct air surveillance and dem dey bomb the places wey terrorists’ dey hide for some parts of the country, especially the Northeast and Northwest.

You fit also like to read this one: NNPC in ‘locked pact’ to supply Dangote refinery crude oil for 20 years.

As things dey now, the Force get 38 new aircraft, including 12 A-29 Super Tucano aircraft wey government just buy. Some wey still dey na Im dem dey use dey train dia pilots.

Amao, wey deliver one paper titled “Management of Emerging Air Threat: Implications for strengthening Governance in Nigeria,” tok say NAF dey buy JET A-1 for N950 per liter against N360 wey e suppose be.

You fit go read more of the tori for here, CLICK HERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *