fbpx
April 19, 2024

I Collect Wotowoto For Mouth – Yinka Ayefele

0

Ogbonge Nigerian gospel singer, Yinka Ayefele don collect wotowoto for di hand of an operative of Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) wey dey Ekiti state.

Dem talk sey na one Officer wey dem no know na hin punch him for mouth when kasagba burst between dem two.

YOU FIT LIKE  READ: 2023: Tinubu go get plenty Igbo votes, to continue Buhari beta work – Nwoye

Sources kon yarn tori pipu sey di security agent self dey bragado sey hin go shoot di Ipoti Ekiti-born singer on top sey hin no allow am carry money for hin car.

One person wey di kasagba burst for hin front yarn sey na for Iloro Ekiti na hin di thing happen true true , kon add am join sey di officer beg Ayefele for money when hin finish singing for pipu for show but hin no give di officer any money sey na Wetin make him chop di punch be dat.

Yinka Ayefele himself talk sey na true true hin collect punch for mouth for di hand of di NSCDC officer. Oya, shook eye for the full tori. READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *