fbpx
May 5, 2024

Transfer: Nigerian goalkeeper don join Tanzanian club, Tabora United

noble-seal-move-to-tanzanian-club

Super Eagles goalkeeper, John Noble don seal move to Tanzanian Premier League club, Tabora United.

Noble, wey join Tabora United from Nigeria Professional Football League champions, Enyimba, sign one year contract with option of another season.

Di 30-year-old bin dey inside di Enyimba books for three years.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu go address Nigerians today

 

Also, shot stopper spend eight years for Togolese club, ASC Kara before hin link up with Enyimba in 2020.

Noble bin dey part of Super Eagles’ 28-man squad to di 2021 Africa Cup of Nations wey Cameroon host.

Tabora United bin dey promoted to di Tanzanian top-flight last season.

Di new season for di East African kontri go start next month.

You fit go read di tori, Noble don seal move to Tanzanian club…READ MORE