fbpx
March 28, 2024

Nurse arrested for touch lighting one 14yr-old girl

0

Police don arrest One male nurse,way hin name bi Austin Etim hin dey work for General Hospital Calabar becos say hin rape one 14 year old girl inside di male ward of di hospital.

Di management of di hospital yarn one  on Monday afternoon

U FIT ALSO READHIV infected woman call radio station confess say she dey always mix her blood with di zobo drink wey she dey sell 

Di 14 year old girl way bin dey take care of her papa wen dey sick bed for di male ward inside di hospital, while her mama dey run round to get things wen her husband go use bifore di nurse con touch light her on Saturday.

According to tori di nurse use scarf to tie up di girl bifore him touch light her.

Di Permanent Secretary, Ministry of health, MOH , Dr Iwara Iwara tell tori pipol say dey don suspend di male nurse
Hin tok say dey don give di hospital 48 hours to medically examine di girl and produce her medical report

Investigation still dey go on……

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *