fbpx
May 2, 2024

NYSC suppose dey optional – Banky W

NYSC-suppose-dey-optional-Banky-W-

Famous singer wey turn politician, Olubankole Wellington, a.k.a Banky W don explain why di National Youth Service Corps, NYSC suppose dey optional for Nigeria.

Banky W, wey tok this one on Tuesday during interview for Channels Television, yarn say di NYSC program neva achieve everything wey e dey designed for since di existence.

Hin yarn say e no sure say anybody go disagree with am on di matter. NYSC neva achieve everything wey e dey originally designed for today.

Hin later ask say how dem go take improve am?

FOR MORE NEWS: Cuppy marriage to Ryan Taylor – “Call me Mrs. Certi”

Hin opinion be say make dem no cancel am, but make dem remove am from di constitution make am optional, people wey no need am no go.

If them do am like that. pipo wey dey intereted go fit collect better pay instead of paying them N30,000 monthly wey no fit do anything for young person for Nigeria today.

Dem fit dey collect N60 – N80, 000,”.

Na Banky W view on why NYSC suppose dey optional be that. Wetin you thing?

You fit go read di full tori…READ MORE