fbpx
May 2, 2024

Phyno, sickle cell carrier – Shey na true?

Nigerian rapper Chibuzor Nelson Azubuike, wey dey popular with di name Phyno don respond to di tweet wey one of hin fan post for twitter . Di fan tok say Phyno na sickle cell carrier. Pipo sef wey see di tweet go dey wonder weda phyno be sickle cell carrier.

Di fan enter her twitter page tok about her love for Phyno. According to di fan, she say her love grow for di rapper don grow more as she find out say hin get sickle cell”.

FOR FOR NEWS: Phyna bbnaija confess why she komot two belle before age 25

”Since I heard Phyno has sickle cell the love tripled, I pray God grants him the strength to keep fighting.” Na wetin di fan write be that.

 

As Phyno see di tweet of that fan, hin quickly respond to di tweet. Hin say no be true o. After hin talk that one,  hin pray for pipo wey battle di ailment.

”Lol . No I’m not sickle cell. Love to everyone fighting it tho”

Tweet-about-Phyno-sickle-cell-

You go like read di full tori…READ MORE