fbpx
March 28, 2024

Obaseki u dey tok nonsense with confidence-Fani Kayode

0

Di Presidential Campaign Organisation of Tinubu/shettima, yesterday, don come out para for di Governor of Edo State Godwin Obaseki on top di tok tok wen hin yarn say if Tinubu win as Nigeria president say Nigeria go break up

Reacting to wetin Obaseki yarn, Fani-Kayode tok say, “Obaseki you dey tok nonsense with confidence” abi why you go say Nigeria go break up if Tinubu win dis coming 2023 presidential election.so wetin you dey tey tell us bi say na only Atiku fit unite dis country abi? Na small pikin tok bi dat go sit down.

U FIT ALSO READ Na small pikin dey worry obident supporters – Obaseki yan

Fani kayode con still tok say “Obaseki seh you don forget so soon if you no remember i go remember you di Atiku wen you believe say na him be messiah nah him attempt to destroy President Olusegun Obasanjo and his administration from 1999 till 2007 and former President Goodluck Jonathan na him make am loose election for 2015 if you no know make you know”.

“If dis kind of persin con become Nigeria President wetin you think say e go be di outcome, him go destroy Nigeria di kind way him destroyed PDP.

“For those of you wen tok say Bola Tinubu na dictator,make una open una ear hear wetin i wan tok: if Tinubu is a dictator then Atiku na political scammer who cannot be trusted.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *