fbpx
May 5, 2024

Obaseki: We don tackle illegal human trafficking through education, and capacity building

Governor Godwin Obaseki of Edo State don come out tok say di success wey hin administration don record base on di fight against human trafficking and capacity building no bi moimoi oo

Hin tok say dia should bi reform in education programmes and projects to build di capacity of Edo youths and equipping dem dey competitive globally.

U FIT ALSO READ 

Obaseki, while addressing di journalists for Benin hin tok say: “ Di state don try in fighting human trafficking and irregular migration. At some point, in 2016, and 2017, hin tok say dey don record more dan 30,000 young Edo boys and girls, wey don run go Libya just to cross over to Europe.

Hin tok say that kind thing na hin oyinbo pipol dey call “human horror” na real big tragedy e bi to most of dem,

Obaseki tok say,“ hin find dat kind situation depressing and hopeless but di situation bi say, hin thank God say hin dey work with International Organisation for Migration, IOM.hin tok say dey don also set up Edo State Taskforce Against Human Trafficking, ETAHT, to fight problem wey fit lead to human trafficking.

Wen tori pipol ask am how di government take tackle di case? di governor tok say: “ dem do am through gathering of data and information on why a lot of young pipol dey leave di country.

To read di full tori CLICKHERE