fbpx
May 19, 2024

Ogun govt don close road for Abiodun inauguration

ogun-state-shut-down-roads

Di Ogun State Government don shut down some roads for Abeokuta, di Ogun State capital, in preparation for Governor Dapo Abiodun second term inauguration.

Abiodun inauguration go happen today for di MKO Abiola International Stadium, Kuto, Abeokuta.

Also, di Traffic Compliance and Enforcement (TRACE) Corps, tell di motoring public say traffic rerouting go dey around di stadium axis dis morning.

Akinbiyi yarn say alternative routes and parking spaces go dey mapped out and supervised by security and safety officials.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu inauguration go strengthen me, I no be saint – Peter Obi

 

In addition, he explain say all buses wey dey come from outside Abeokuta through di Sagamu/Interchange for di inauguration go dey diverted for di NNPC to di right towards Abiola-Way-Leme Junction, to make U-turn to di left inbound NNPC. Dis na before dem make right turn to di stadium through di road/gate opposite Providence Hotel.

He add say access no go dey to di road for vehicles coming from Iyana/Mortuary towards NNPC, except those one wey dey scheduled for di event.

You fit read di tori as Ogun State shut down roads...READ MORE