fbpx
April 26, 2024

One persin don kpai and di other dey hospital as Gunmen abduct corps member

0

Gunmen on Tuesday night don abduct some corp members, Adenike, and seven others for Extension 2 Relocation, along Arab Road, Kubwa area of di Federal Capital Territory, Abuja.

According to tori di gunmen bin kidnapped Adenike, for her papa house, na she bi di only daughter of her parents, and other pipol join for di kidnapping matta after di attack.

U FIT ALSO READ “Stop to dey demonize CS” – Doctor advise as woman lose her womb and baby after she no gree undergo CS because of religious beliefs

Two pipol na hin escape wen di kidnappers dey carry dem away through the hills.

According to tori unknown gunmen kidnapped Adenike, way bi di landlord only daughter, currently dey do her NYSC.pipol bin dey confuse now becos say seven other pipol too dey miss right now.

Di gunmen attack diresidence for Extension 2 Relocation, along Arab Road, in Kubwa, and shuut two males, as one of dem die instantly after di gunshot on dat spot, as dem rush di other persin go hospital.

During di attack, one eyewitness tok say di gunmen just dey shuut anyhow like say dem dey do American film for Amilomania Street and later move to Toyin Street.

Hin tok say dem bin hear sound of gun like two times twice wen dey first enter di house for Amilonania Street.

According to report we hear say those gunmen escape through di hill on dat Tuesday night.

Tori pipol tok say wen dey contact, the FCT Police spokesperson, Josephine Adeh she no pick dia calls and the same time no respond to dia text messages.

To read full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *