fbpx
April 27, 2024

“Stop to dey demonize CS” – Doctor advise as woman lose her womb and baby after she no gree undergo CS because of religious beliefs

0
CS-for-women

One doctor don advise Nigerians and religious leaders make dem stop to dey demonize Caesarean Section (CS). Hin talk say nothing dey wrong with am.

@drpenking give di admonition for Twitter hin talk about di sad story. Di woman wey dey labour lose her baby and womb because she no gree undergo CS.

He yarn say di woman bin get obstructed labour. Dem advise her make she do CS to save her life and that of di baby but she no gree. She no gree because her pastor tell her say she go ‘deliver like di Hebrew women’.

But, she kon get more complications for di process, di baby died for her uterus and dem kon need to comot her womb.

Dr Penking advise Nigerians make dem stop to dey criticize Caesarean Section because na life-saving procedure and e no dey reduce woman.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *