fbpx
April 19, 2024

Gunmen rob Archbishop comot cloth for hin bodi,for imo

0

Pentecostal Archbishop and Presiding Officer of Unifaith Living Church Incorporated, Paul Hanson, don narrate how some gunmen rob am on him way to Anambra State to consecrate a new Bishop-elect named Norman Okeorimili.

Hanson tok say di incident happun for Akata Market Square, Orlu, Imo State, on Sunday at 2pm.

U FIT ALSO READ Insecurity: bandits don kill Zamfara monarch

Hin tell tori popol say wetin happun dat day no fit pass di work of those yeye hoodlums, during di consecration ceremony of di bishop-elect for Ogidi, Idemili North Local Government Area of Anambra State, on Sunday.

Di cleric, bin dey drive from Akwa Ibom State, on hin way to Anambra hin tok say those hoodlums collect hin car, regalia, rank badge, money, six phones, among other belongings, dem comot di cloth wey hin wear con leave only pant for hin bodi.

Di cleric with vexnation tok say why pipol go just think for dia bad mind say na man of God dem wan rob. Why?

Hin tok say,” Di incident happen for Akata, Orlu market square, for Imo State, while hin dey come from Akwa Ibom State, to consecrate di Bishop-elect of our church, Norman Okeorimili, in Ogidi.

Hin tok say dat car wey dem see so na persin buy di car for ram, di same persin still help am to di Police Area Commander and from there hin call hin Divisional Police Officer for Akwa Ibom and marrare wetin happun give am.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *