fbpx
May 5, 2024

Transfer: Osimhen fit no comot for Napoli dis summer – Agent

osimhen-go-remain-for-napoli-dis-season

Italian agent, Oscar Damiani dey expect say Victor Osimhen go remain for Napoli beyond dis season as he claim say e go dey difficult for any club to meet up with Napoli valuation of di Nigerian.

Osimhen don dey in brilliant form for di Partenopei dis season, and hin attract di interest of di likes of Chelsea, Manchester United, Bayern Munich and Paris Saint-Germain.

Napoli president, Aurelio De Laurentiis fit ask fot €150m for di striker.

 

However, Damiani claim say no clubgo dey willing to pay dat kain big money for di 24-year-old.

“There is no club in the world that can really offer this money (€150million) to Napoli. I’m sure Osimhen will stay another year in blue and will continue to be a point of reference for the club,” Damiani tok as per Napoli Magazine.

Osimhen don score 28 goals in 36 appearances across all competitions for Luciano Spalletti side dis season.

Osimhen go remain for Napoli, You fit go read di tori…READ MORE