fbpx
May 3, 2024

“Burna Boy Sacrifice Im Manhood” – Twitter User Yarn, Talk Say Artist No Born Pikin by 30.”

Otedola-call-out-Burna-Boy

“Twitter User Bayo Otedola call out Burna Boy say e never get pikin for im 30 years. Dis tori come after pesin talk say make dem start argument wey go bring wahala for Twitter.

Bayo quote di tori talk why Grammy Award-winning artist Burna Boy never get im own pikin like oda musicians wey be im colleagues for music industry.

E talk say, “Burna Boy sacrifice im manhood, because why 30-year-old go dey without pikin?”

 

FOR MORE NEWS: Darkness go cover some places for Abuja because TCN dey do maintenance.

 

People come yan different things about di tweet. Some talk say Burna no be di only artist wey never get pikin for Africa, say everything dey get time. Anoda talk say, “Abraham get pikin when e dey 91, so I believe say Burna no sacrifice anything, e just dey wait for God’s perfect time.”

Some pipo still yan say dem support di tweet, talk say Burna pullout game fit no strong like dat. Oda pipo yan say make dem check how many pikin Don Jazzy get. Some even talk say dem dey smell 1 billion Naira wahala wey fit land dem for court. Another person talk say, “Wetin you dey cook na wah oh.”

You fit go read di tori see Otedola wey call out Burna Boy….READ MORE