fbpx
May 3, 2024

“Wizkid dey di same level wit Michael Jackson, Drake, Rihanna” – South African singer Tyla

tyla-put-wizkid-for-drake-level

South African musician, Tyla, don waka put Afrobeats artist, Wizkid, for di same level wit ogbonge musicians like Drake, Rihanna, and di late Michael Jackson.

Wen dem ask Tyla for interview on The Bianca Show to talk di top five musicians wey she feel say dem be di best of all time, di “Water” singer yan Michael Jackson, Britney Spears, Drake, Rihanna, and Wizkid.

She explain say she add Wizkid to di list because of im influence and how long e don dey inside African music industry.

 

FOR MORE NEWS: “Why I Dump All My Ex-Girlfriends” – DJ Cuppy Ex-boyfriend, Ryan Taylor

 

Tyla yan say, “My top five musical artists of all-time, obviously, Michael Jackson, Rihanna, Drake… E dey always hard to choose di last one.”

“Also eget many, but I go talk say Wizkid. E don dey for long and e don do many tins for di culture and di genre [African music], so I go put am for there.”