fbpx
April 27, 2024

Bishop Oyedepo pikin Isaac don dump Living Faith, to start new church

pastor-isaac-don-resign

Pastor Isaac Oyedep0, one of Bishop David Oyedepo pikin, founder of Living Faith Church, aka Winners Chapel, don resign.

Isaac, wey dem recently appoint as di Global Youth Pastor of di Living Faith Church Worldwide, resign to start up hin own ministry.

Hin yarn say hin God-given mandate na to reclaim a generation and to ensure say this generation see di fire of God-revival for our generation.”

Pastor Isaac wey don resign be di second pikin wey Bishop Oyedepo get.

 

FOR MORE NEWS: Mr Ibu health critical, two surgeries following body decay

 

Him and hin elder brother, David Jr., bin dey ordained as pastors in May 2007 by Kenneth Copeland.

Also, hin be graduate of Oral Roberts University and hin don serve as di resident pastor of di Living Faith Church International, Maryland, USA, since October 2018.

Isaac dey married to Ayomitide Oyedepo and dia union dey blessed with four children.

You fit go read di tori…READ MORE