fbpx
April 25, 2024

PDP don call emergency meeting as dem governors and others gang-up

0
PDP-National-Chairman-Dr-Iyorchia-Ayu-emergency-meeting-.

On Wednesday, the leadership of the Peoples Democratic Party call for emergency meeting because of some Governor like Nyesom Wike of Rivers State, hin Oyo State counterpart, Seyi Makinde, ex-Information Minister, Prof. Jerry Gana, and other prominent party chieftains decide to comot from the party presidential campaign council.

The Wike camp announce their plan say dem no go join the campaign council wey dey scheduled for inauguration next Wednesday after the meeting for Wike private house wey dey Port Harcourt, Rivers State, on Wednesday morning.

YOU STILL FIT ENJOY: PDP crisis: I no fit force Ayu make hin resign, Atiku insist

Dem yarn say dem make that decision because the party Chairman, Iyorchia Ayu no gree resign from hin office, hin dey demand say  the position must go South for balance, justice, and equity.

Before all these things happen, the main opposition party bin don go on marathon meeting total the matter well so that dem go see the impact of the withdrawal on the party plans.

You fit CLICK HERE go enjoy more of the tori for Punch.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *