fbpx
April 18, 2024

People shock eye for Queen Casket for the first time after she Kpai

0

The Queen of England’s coffin don commot for Balmoral enter road to the palace of the Holyroodhouse wey dey Edinburgh. This go be the first time wey people go see the casket of the Queen since she change address.

The casket dey covered with the Royal Standard of Scotland, as dem use flower decorate the top of the casket’.

Since the Queen kpai on Thursday, the body bin dey for the Balmoral ballroom, so that estate workers go get chance there to say goodbye for the last time.

Six of the estate’s gamekeepers na dem carry mama lcoffin into a hearse at 10am, to enter journey wey go last six-hour to the Scottish capital.

According Nicola Sturgeon, the country’s first minister, him yarn say journey go give people wey dey Scotland the chance to say bye for now to mama and to “share for the big loss wey happen so”

People go begin come see the Queen corpse from 5pm on Monday and dem do warn the public say, no room for plenty photograph and video recording.

On Tuesday, Princess Anne go fly enter London with her mama body.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *