fbpx
May 1, 2024

Unknown Person Don Stab 43Years-Old Cash App founder, Bob Lee To Death

person-stab-cash-app-founder

An unknown person don stab Tech executive and founder of Cash App, Bob Lee to death for San Francisco, California at di age of 43.

Di tech mogul, wey formerly serve as di di chief technology officer of Square, bin dey attacked inside di city downtown Rincon Hill neighborhood at 2:35 a.m. Also, dis incident happen on Tuesday morning, April 5, according to San Francisco police.

FOR MORE NEWS: Find another person, make we do engagement – Omoni Oboli dey tell Alexx Ekubo

Officers reach di scene to find di 43-year-old man, wey dem later confirm to be Lee by CBS News, with multiple stab wounds. Person stab di 43 year old Cash App founder, dem carry Bob go nearby hospital before hin surrender to hin injuries, na wetin police tell di outlet.

As di matter be now, dem neva make any arrest as early Wednesday. San Francisco police neva release any suspect details, na wetin di outlet add be dat.

You fit go read di tori…READ MORE