fbpx
April 23, 2024

Tinubu’s victory: Peter Obi court case na joke, e no dey go anywhere – Fani-Kayode to Obidients

peter-obi-court-case-na-joke-Fani-Kayode-to-Obidients-

Former Aviation Minister, Femi Fani-Kayode don describe di Labour Party, LP, presidential candidate, Peter Obi court case wey dey challenge di President-elect, Bola Tinubu as joke, and hin say di one to Obidients.

Fani-Kayode yarn say di court case no dey go anywhere and say Obi go come out dey cry.

Di LP presidential flagbearer lose during di 2023 contest. Despite coming third, Obi don insist say hin won di election.

In view of hin claim, Obi don go court to challenge Tinubu victory.

However, Fani-Kayode yarn say Obi move na waste of time.

FOR MORE NEWS: Tribunal give Obi 21 days for hearing on election petition

Inside message to Obi followers, Obidients on Twitter, Fani-Kayode mock di LP followers over dia inability to win any state for di governorship election.

Na wetin hin tok be dis, “Dear Obidients, hear this and eat it: your Obidient bubble has burst forever. From now on it is downhill for you. You are now in political oblivion and you will remain there.

“Your hateful and divisive disposition and cause and your religious and ethnic bigotry has destroyed you.

“As for your court case challenging Asiwaju, it is the joke of the century. It’s not going anywhere and you will come out crying.

“We shall spank you hard there and flush you down the toilet just as we have done in all the elections.”

You fit go read di tori…READ MORE