fbpx
May 12, 2024

“I am consistent; you can call me Peter Jr.” – GRV don open up on how Peter Obi inspire am

peter-obi-grv-don-open-up

Famous Labour Party Governorship candidate, Gbadebo Rhodes-ViVour aka GRV don address di controversy wey surround hin ancestry as he tok about how Peter Obi inspire am.

Gbadebo Rhodes-ViVour ancestry Peter Obi

 

FOR MORE NEWS: INEC fault judgment wey permit Temporary Voters Card for polls

 

Di guber candidate for interview yarn say most of di people wey dey criticize am no be real indigenes of Lagos. He mention how di past and present governor no be indigenes.

According to am, di former Lagos state governor, Bola Ahmed Tinubu na indigene of Iragbiji while di present governor, Babajide Sanwo-Olu na from Ijebu.

In addition, Gbadebo Rhodes-ViVour yarn say hin ancestry wey dey beyond dispute go back to 200 plus years. Also, hin tok say hin fit easily present receipts of four generations.

He dismiss di rumours about am wey tok say hin dey petty. Also, hin add say di pipo wey dey do those things dey do am because dem no get anything better to demarket am with.

 

 

 

Also, as hin tok on di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, hin describe am as principled man wey stands by hin word.

In addition, GRV yarn say Peter Obi inspire am to be better politician and e no go  mind if dem refer am as Peter Jr.

You fit go see di full tori…READ MORE