fbpx
May 6, 2024

Peter Obi lead mega LP rally election for Edo

peter-obi-lead-mega-lp-rally

Mr Peter Obi of di Labour Party LP on Monday for Benin City, lead mega rally for di party ahead of di September 2 local government area election for Edo State.

As hin dey address di teeming party members and supporters wey come out for di event, Obi describe di local government area system as “where development is dey”.

Hin yarn say Local government na di closest to di people and e suppose be root of ensuring development for di pipo.

Also, hin tok say di three most critical areas of development na health, education and poverty eradication and na di responsibilities of di local government.

“So, for di system to work, for di kontri to develop well, na di local government hand e dey.

Hin tok say when hin be governor, hin bin no fit conducting local government elections for over six years.

So, dem organise di rally today to support dia candidates for di forthcoming local government election for Edo.

 

FOR MORE NEWS: Davido pause performance to pay touching tribute to Wizkid late mama on stage

 

As Peter Obi lead mega LP rally, hin, task voters for di state make dem vote en masse for candidates of di party for di election. Also, hin assure dem say say if dem vote,  dia future go dey protected.

Speaking earlier, di National Chairman of di Labour Party, Mr Julius Abure, commend Gov Godwin Obaseki as hin put modalities in place for di conduct of di election but hin giving warning say di election must be free and fair.

Also speaking, Mr Olumide Akpata, governorship aspirant for di 2024 election for Edo, follow advise electorate make dem no entertain fear but to go out vote all LP candidates for di election.

Akpata, immediate past President of di Nigerian Bar Association (NBA) yarn say di candidates na persons of impeccable character, wey fit deliver on di programmes of di LP, NAN reports.

You fit go read di tori…READ MORE