fbpx
May 6, 2024

Sanwo-Olu spark reactions with hin N160 million wristwatch amidst economic hardship

sanwo-olu-wristwatch-stir-reactions

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don stir reactions online with hin exotic collection of a Patek Philippe wristwatch wey dey estimated to sell for N160 million.

Dis one dey come amidst di poverty and inflation wey dey bite hard on plenty residents of Lagos and other part of Nigeria because of di fuel subsidy removal.

Also, na one social commentator Feyi Fawehinmi on Sunday afternoon na hin share di wristwatch alongside di watch price for di Chrono24 website, and na platform where rich pipo for di world dey shop for dia wrist candies.

Chrono 24, on top dia website, peg di wristwatch price at £136,189, about N160 million, based on di current exchange rate of N1,170 per pound.

Dis one spark mixed reactions from netizens as some claim say Sanwo-Olu luxury lifestyle no be new thing, while others claim say e no dey right.

 

FOR MORE NEWS: Cubana Chief Priest 6 year old son don become CEO

 

See some reactions below:

swag_omoluabi wrote: “Lol, Sanwo-Olu has been a fashion enthusiast even before he became governor.”

princesssholly24 wrote: “What if it was a gift? moreover The guy can comfortably afford it since his days of being commissioner in Lagos.”

onyin wrote: “Some of una wey Dey criticize am,if na una papa Dey that position I know you guys will do more than what he’s doing…..make una leave person papa alone!”

chigoziedouble wrote: “Na Lagos tax payments money he dey chop dey enjoy while people never collect the 8k wey the president promised us.”

You fit go read di tori see as Sanwo-Olu wristwatch stir reactions…READ MORE