fbpx
April 19, 2024

Peter Obi Na Deceiver- Dele Alake Yarn Nigerians

0

Di Director of Strategic Communication for di All Progressives Congress (APC) presidential campaign council, Dele Alake, don talk sey he no go beg any Peter Obi supporters on top di talk wey hin talk .

Alake don drag Peter Obi wey be Former Anambra state Governor wey hin still be the current Labour Party presidential candidate sey he be big time deceiver.

Na for one NEWS CENTRAL TV wey he go as guest na there he talk di talk wey be sey Peter Obi pipu wey dey call themselves Obidient na hin dem kon vex sey di talk no good at all.

When Alake kon dey reply dem, he kon stand gidigba sey nobodi fit beat him, he kon sey hin no dey deny anything sey na true true he talk am.

He kon add am join sey di business wey Obi dey do no fit favour di plan wey hin dey lie sey he get for dis kontri. Shook eye to read more

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *