fbpx
April 23, 2024

Goodluck Jonathan – How I take end ASUU strike for one night

0

Former Nigerian President Goodluck Jonathan remember how im administration settle four-month old industrial action wey the Academic Staff Union of Universities (ASUU) start for just one single night.

The former president, wey tok on Wednesday for Abuja when dem dey do the 70th birthday celebration of Matthew Hassan Kukah, say he decicide to organize one conference between top government officials and the leadership of the striking lecturers after other methods wey dem bin wan use settle the matter fail.

You fit also enjoy: Indefinite strike: FG don call varsity councils, vice-chancellors as parents dey complain.

According to am, im decision to engage the union to settle the matter peacefully, come from the hardship of students who dem force to remain for house for four-months.

He say despite im presence and that of im deputy, Namadi Sambo, the Attorney General of the federation, ministers of finance, labour, education and other top officials, the meeting last for a whole night.

He say, “The society wey dem dey manage, dey hard, now dem dey talk about the ASUU strike. During my time too, ASUU bin dey four months strike, different committees gather do meeting upon meeting but nothing work. I kon say, how our pikin no go dey for school for four months? So I kon need to call meeting with all the leadership of ASUU. Na former President Goodluck Jonathan dey tok this one.

You fit go read more of this story, CLICK HERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *