fbpx
May 18, 2024

Obi Charge Nigerians for Peaceful Co-existence

peter-obi-sallah-message-to-Nigerians

Labour Party presidential candidate for di 2023 election, Mr. Peter Obi inside Sallah message, don charge Nigerians make dem no allow di hardship and provocative attitudes of leaders for di kontri to affect dia faith in God, wey go make possible a better and prosperous Nigeria.

Peter Obi, inside hin Sallah message tweet, hin advise di Muslim faithful wey dey celebrate di great feast of Eid-El Kabir say make dem get di spirit of love, brotherliness, and peaceful co-existence. He yarn say every faithful patriot must continue to serve God and di Kontri selflessly.

Di LP standard bearer yarn say make di pipo use dis year Eid-El Kabir festivities to engender the spirit of oneness and also re-dedicate themselves to di virtues of love, patriotism, and unity for di desired national development.

 

FOR MORE NEWS: Bayelsa Guber: Poll Predict Gov Diri Victory

 

Also, di former Anambra State Governor note say ceremonies like dis na opportunity to appreciate our creator wey show us plenty mercy and grace even when we no deserve am.

Obi also asked Nigerian Muslims make dem use di solemn period of Sallah to present Nigeria discomforting situation to Allah for hin prompt intervention.

He yarn say di poor leadership dey threate our nationhood and we need to seek God intervention but he advise Nigerians make dem devote themselves to di values wey unite and bind all citizens in love.

You fit go read di tori…READ MORE