fbpx
May 2, 2024

Phyna bbnaija confess why she komot two belle before age 25

Phyna bbnaija Confess wey be the winner for the Season 7 don touch light her past, wetin happen, wey make her komot belle (Abortion) when she dey age 19, 24.

 

Phyna bbnaija wey be 25year old touch light this matter during interview with Punch. During the interview, Phyna confess say nah true say she don do two abortion when she dey age 19 and 24.

Phyna yarn say people just like to dey shook mouth for matter anyhow. For my family, we dey open, just be like book wey dey open. When people begin dey read meaning to my past, I just dey laugh. The truth be say, I no care, anything wey dem like may dem use dia mouth talk, na dem sabi.

“I no dey ashamed of myself, if I do mistake, I gree say nah mistake and I ready take full responsibility. So, when the woman accuse me say I be Abortionist, I tell her straight say yes na true say I commit abortion. Even when my Papa call me say why I go talk that kind thing, I just tell am say, daddy nah from you I learn am.

98 OUT OF 100 Naija women don do abortion – Phyna BBnaja Confess

Phyna BBnaija confess say: May we no form holy, holy, 98 percent of naija women don do abortion, so may nobody turn judge for my matter. When the first one happen, I dey 12 year relationship that time and I still be small girl that time. As I know fit go home go tell my Papa and Mama say, I don get belle, na wetin Make me use tablet komot the belle, Phyna BBnaija confess.

“Second belle happen after I finish my NYSC and I dey ready then to keep the belle but as I see say the relation relationship get k-leg as my boyfriend then dey abuse me, always beating me, so I tell myself no be the kind Papa wey I want for my child be this, nah wetin make me komot the belle..Phyna BBnaija Confess. The two belle wey I get dey two to three week before I used tablet komot am.

I family dey poor, so If I born pikin wey I no fit take care, that one no make sense at all.

 

I know say “Abortion na sin to God, but I don pray as Catholic wey I be say, May God forgive me, Phyna confess.

You like read: Herbalist give customer belle for Kano