fbpx
April 24, 2024

Hoodlums set Ogun INEC office on fire

0

Some suspected hoodlums don set fire for office of Independent National Electoral Commission (INEC) for Iyana Mortuary, Abeokuta, inside Ogun State capital.

According to tori wen we hear di hoodlums,reach eight in numbers,and na fence dey bin jump enter into di premises,and dey con put fire for INEC building from di backyard

U FIT ALSO READ Hoodlums attack Atiku campaign convoy for Borno

Tori been yarn say na bread wen dem soak with petrol na him dem take set fire for di building

Di security guard wen dey guide INEC office,Azeez Hamzat,tok say wen di fire dey happun around 1am hin call police pipol

But police of Ibara division tell am say make hin no worry say dey don send some of dia guys to di area

At di same time him call fire fighters, who con later quench di fire

According to tori many things been lost for di fire both non-sensitive and sensitive materials na hin fire destroy but we thank God say nobody kpai for di fire incident.

Ogun INEC Electoral Commissioner, Niyi Ijalaye, after hin confirm wetin sup hin tok say fear catch am and him no dey happy at all.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *