fbpx
April 29, 2024

“I tell Yul Edochie say I see danger for hin pikin before e die”- Prophetess yan another warning

yul-edochie-pikin-prophecy

Prophetess talk say before Kambili, Yul Edochie pikin die, she tell the actor but e no gree the prophecy. She yarn say she bin warn Yul for video before hin pikin die but e no take am serious. Also, she talk say she tell Yul say di “other woman” wey enta between am and hin wife, May, dey get power and work to do for hin family. She add say because Yul no gree gree di first prophecy wey cause hin pikin Kambili die, di rest of May Edochie children no dey safe. She talk say she see another vision wey show say another pikin of May go die.

 

FOR MORE NEWS: Return bride price wey I pay, una no gree,” Yul Edochie yan im wife, make she return bride price.

Prophetess talk for di video say, “Yul Edochie no gree my revelation for February 5th, 2023. I tell am wetin I see wey go happen, who dey responsible, and wetin e suppose do. E no do am, e no tell hin wife. I no get hin wife number, and hin pikin loss happen di next month. I see another plan but back to sender.”

For di video, she sound concern as she emphasize say Yul suppose take her talk serious for di safety of hin family. She talk say she don already see anoda revelation wey show say anoda pikin of May fit dey danger. She yan say di plan wey she see na bad one, but she dey pray make di plan go back to di person wey plan am.

You fit go read di tori about Yul Edochie pikin prophecy…READ MORE