fbpx
May 3, 2024

‘No disrespect to Davido’ – Portable clear air on song with Dammy Krane

portable-song-with-dammy-krane

Controversial singer, Habeeb Okikiola, wey pipo sabi as Portable, don clear di air on hin collaborative song with Dammy Krane no be diss track directed to Davido, as pipo dey think.

According to reports wey appear on top social media, Portable and Dammy Krane bin record diss track against Davido during dia studio session. And na di time wey Davido and Dammy Krane dey fight over debt.

Reacting to di rumours via video message wey dey make rounds on X, Portable explain say hin studio session with Krane na strictly business. Also, hin tok say e no get anything to do with hin beef with Davido.

He explain say hin studio collaboration with Dammy Krane na purely business venture and e no get connection to hin dispute with Davido.

 

FOR MORE NEWS: “RIP Mohbad” – Small Doctor freeze for stage, as late Mohbad song play

Di ‘Zazu’ singer, Portable add say di song wey hin record with Dammy Krane na prayer song.

As Portable dey tok for pidgin, hin yarn say, “Dammy Krane sing with me una say we insult Davido. Na strictly business. Music na business.

“Now, because of say Dammy Krane dey fight with Davido make we no sing together? Uncle Dammy Krane and uncle Davido make una forgive each other.” Na wetin Portable tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE