fbpx
May 4, 2024

“RIP Mohbad” – Small Doctor freeze for stage, as late Mohbad song play

Small-Doctor-freeze-for-stage

Nigerian Fuji and afro-pop recording artist and performer, Adekunle Temitope, wey dey known by hin stage name Small Doctor, freeze for stage during hin recent show when di song of late Nigerian singer, Mohbad, start to play.

Ilerioluwa Oladimeji Aloba, wey dey known as Mohbad, bin dey reported dead earlier in September because of di claim of ear infection.

While di cause of hin death neva dey reveal by di authorities, fans and well-wishers of di late singer continue to mourn hin loss.

Several weeks after Mohbad death, Small Doctor bin dey for one recent event, when hin almost cry for stage as  Mohbad song dey play.

Plenty pipo wey bin wan view di video immediately enter di comment page to join Small Doctor mourn his late friend, Mohbad.

 

FOR MORE NEWS: Na grace I survive 2020/2021”- Annie Idibia narrate her years of marital crisis

 

See some reactions below:

donalex791: “‎RIP mohbad.”

Adorable: “‎this kind people go feel ham most becos, Dem too go dey think say if Dem die now, the love will be massive.”

OPELOYERU: “‎why now, see me crying on bed,omoh this one too bad for us to handle ooo.”

Fiddy Tea: “‎I swear to God if my tears can bring you back like I will not stop imole forever in my heart we have miss you imole.”

You fit go read di tori see as Small Doctor freeze for stage…READ MORE