fbpx
April 25, 2024

FG dey use uncompleted projects as trick for next year elections – Adegboruwa

0
FG-and-uncompleted-projects

Legal practitioner Ebun-Olu Adegboruwa (SAN) don accuse di Federal Government say dem dey use projects across di country as trick to get votes and continuity for next year general election.

Adegboruwa talk this one on Tuesday when hin appear as guest for Channels Television Sunrise Daily to discuss matter wey concern INEC and di elections.

He yarn say di federal government dey use projects as trick to tie di hands of Nigerians so that dem go get continuity and e dey very wrong.

YOU GO LIKE READ: 11 Ways to maintain a healthy lifestyle

Hin still talk say dem promise to complete di Second Niger Bridge for 2022,e don already enter December and e still dey there. How long e go take make dem complete Lagos-Ibadan expressway wey dey about 200 km?

Hin still share hin personal experience, he say he don pass that road before and hin nearly kpai.  Hin yarn say hin know people wey don kpai and wey don get serious health challenges because dem pass that road.

Na inside Vanguard this tori dey…READ MORE

For more news: INEC dey battle 600 court cases over candidates nomination

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *